Sentence view
Universal Dependencies - Naija - NSC
Language | Naija |
---|
Project | NSC |
---|
Corpus Part | dev |
---|
showing 601 - 700 of 990 • previous • next
# as I sit down < # na so >+ one client come dey meet me //
s-601
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__66
# as I sit down < # na so >+ one client come dey meet me
As I sat down, this one client was trying to get to know me.
# e come start dey give me one kind gist //
s-602
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__67
# e come start dey give me one kind gist
Then he started telling me some funny gossip.
I just look di guy //
s-603
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__68
I just look di guy
I just looked at the guy.
# di gist be sey [ e say a'ah ] //
s-604
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__69
# di gist be sey [ e say a'ah ]
The gossip is that, he said, ahah!
# sey im hear sey # di woman # wey own dis place ( im no know sey [ na my mama ] ) || # sey di woman wey own dis place # sey na only one pikin >+ she get //
s-605
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__70
# sey im hear sey # di woman # wey own dis place ( im no know sey [ na my mama ] ) || # sey di woman wey own dis place # sey na only one pikin >+ she get
He heard that the woman who owns this place (he didn't know she was my mother), he said that the woman who owns this place, that she only has one child.
# a'ah !//
s-606
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__71
# a'ah !
Ahah!
I say [ haba Simbo wetin dis guy dey talk ?//] //
s-607
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__72
I say [ haba Simbo wetin dis guy dey talk ?
]
I said, ahah, Simbo what's this guy saying?
# only one pikin >+ she get ?//
s-608
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__73
# only one pikin >+ she get ?
She has only one child?
# and she no get husband //= # and na her boy friend &//
s-609
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__74
# and she no get husband
= # and na her boy friend &
And she doesn't have a husband, and it's her boyfriend...
she dey || she dey sleep wit all dese { young |r young } men //
s-610
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__75
she dey || she dey sleep wit all dese { young |r young } men
She is... she is sleeping with all these young men.
# and na im >+ dey give am //
s-611
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__76
# and na im >+ dey give am
And he's the one giving it to her.
# my people < you see dis kind problem ?//
s-612
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__77
# my people < you see dis kind problem ?
My people, do you see this kind of problem?
# I no know //
s-613
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__78
# I no know
I don't know...
# why rumours ?//
s-614
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__79
# why rumours ?
Why rumours?
why we too dey carry rumours ?//
s-615
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__80
why we too dey carry rumours ?
Why do we really like spreading rumours?
# you no know your fact //
s-616
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__81
# you no know your fact
You don't have the facts.
you no know anyting //
s-617
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__82
you no know anyting
You don't know anything.
# now I con call dis guy later on //
s-618
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__83
# now I con call dis guy later on
Now, I called this guy later on.
# di next day < # I leave am make im dey talk im talk //
s-619
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__84
# di next day < # I leave am make im dey talk im talk
The next day, I let him say all he had to say.
# we { laugh |r laugh |r laugh } //
s-620
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__85
# we { laugh |r laugh |r laugh }
We laughed all through.
# next day < I come call am aside //
s-621
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__86
# next day < I come call am aside
Then the next day, I called him aside.
I say # [ come !//= make me !//] &//
s-622
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__87
I say # [ come !
= make me !
] &
I said, come let me...
ah { my || my || my } chairman < come !//= moh we talk !//= moh we yarn !//
s-623
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__88
ah { my || my || my } chairman < come !
= moh we talk !
= moh we yarn !
Ah, come on boss, come, let's talk, let's talk.
# I come pull am to one side |c tell am sey # [ see # dat your story { wey you hear || wey you || wey } you dey yarn yesterday < dat tory you tell me yesterday < # di ting no sweet me ] //
s-624
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__89
# I come pull am to one side |c tell am sey # [ see # dat your story { wey you hear || wey you || wey } you dey yarn yesterday < dat tory you tell me yesterday < # di ting no sweet me ]
I then pulled him to one side and told him 'look, that story of yours you heard, that you... that you were telling me yesterday... that story you told me yesterday, it did not please me.'
# because < dis gym < # na my mama gym //
s-625
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__90
# because < dis gym < # na my mama gym
'Because this gym, is my mother's gym.'
# first of < # she get children //
s-626
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__91
# first of < # she get children
'First and foremost, she has children.'
no be just one pikin >+ she get //
s-627
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__92
no be just one pikin >+ she get
'She doesn’t have just one child.'
# she get children //
s-628
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__93
# she get children
'She has several children.'
I be her last pikin //
s-629
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__94
I be her last pikin
'I am her last child.'
# and # me wey dey talk to you < I senior you wit like { two |c three } years //
s-630
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__95
# and # me wey dey talk to you < I senior you wit like { two |c three } years
'And me, talking to you, I am older than you by two or three years.'
# we get oder four &//
s-631
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__96
# we get oder four &
'We have four more...'
# I get four siblings //
s-632
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__97
# I get four siblings
'I have four siblings.'
# some of dem { don marry |c don get children } finish //
s-633
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__98
# some of dem { don marry |c don get children } finish
'Some of them are married with children.'
# so # and di fact wey be sey [ de talk sey [ she dey follow young men ] ] < my mama is happily married //
s-634
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__99
# so # and di fact wey be sey [ de talk sey [ she dey follow young men ] ] < my mama is happily married
'So... and the fact that... you were saying that she is chasing after young men, my mother is happily married.'
# my papa dey alive //
s-635
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__100
# my papa dey alive
'My father is alive.'
# so na so >+ one tin led to anoder |c I con become good friends wit dis client //
s-636
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__101
# so na so >+ one tin led to anoder |c I con become good friends wit dis client
So, that's how one thing led to another and I then I became good friends with this client.
# and ehm as God con bless us extra < # we con move from Murtala Square //
s-637
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__102
# and ehm as God con bless us extra < # we con move from Murtala Square
And uh... as God blessed us even more, we moved from Murtala Square.
# God bless us //= we con buy our land //= # we come build our structure ontop am //
s-638
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__103
# God bless us
= we con buy our land
= # we come build our structure ontop am
God blessed us, then we bought our land and we built our structure on it.
# till today < # dis client # { still dey come || still dey come } dis gym |c # and im don become # like family to us now //
s-639
KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__104
# till today < # dis client # { still dey come || still dey come } dis gym |c # and im don become # like family to us now
Even today, this client still comes in, still comes to this gym and, he has become, like a part of our family now.
alright if you listening to me < # dis one na my own little parsee of # how my first day { of || at } { ehn school || Kaduna State University basically } # was //
s-640
KAD_13_Entering-University_MG__1
alright if you listening to me < # dis one na my own little parsee of # how my first day { of || at } { ehn school || Kaduna State University basically } # was
Alright, if you're listening to me, this is my own little story of how my first day of... at uh... school, Kaduna State University basically went.
# so { before |r before } I bin dey hear sey [ university na one kind big place wey be sey you just come # you know # meet people as in ] //
s-641
KAD_13_Entering-University_MG__2
# so { before |r before } I bin dey hear sey [ university na one kind big place wey be sey you just come # you know # meet people as in ]
So a long time ago, I was hearing that the university is a big place where you come to, you know, and meet people, as in...
# my own mindset towards dis tings be sey # you &//
s-642
KAD_13_Entering-University_MG__3
# my own mindset towards dis tings be sey # you &
My mindset towards these things is that you...
when you enter university < # you get to meet { di big shots |c # different kind of guys } like dat |c but # mehn di kind picture wey I con see for dere mehn < # di part time tire me walahi //
s-643
KAD_13_Entering-University_MG__4
when you enter university < # you get to meet { di big shots |c # different kind of guys } like dat |c but # mehn di kind picture wey I con see for dere mehn < # di part time tire me walahi
When you get into the university, you get to meet the big shots, different kinds of people, but guys, the kind of picture I saw over there, guys... I got tired of the part time program, I swear to God.
# so when I enter now < # as per # jambitos now < di usual parade be sey # [ university de no get assembly ] //
s-644
KAD_13_Entering-University_MG__5
# so when I enter now < # as per # jambitos now < di usual parade be sey # [ university de no get assembly ]
So when I came in as a freshman, the usual practice is that in college, students don't gather together on the assembly ground.
# I con jam one guy now //
s-645
KAD_13_Entering-University_MG__6
# I con jam one guy now
So I met a guy, by chance.
# I con dey like reason wit di guy //
s-646
KAD_13_Entering-University_MG__7
# I con dey like reason wit di guy
I started enjoying hanging out with the guy.
guy < # what 's up now ?//
s-647
KAD_13_Entering-University_MG__8
guy < # what 's up now ?
Man, what's up?
where be di assembly ground ?//
s-648
KAD_13_Entering-University_MG__9
where be di assembly ground ?
Where's the assembly ground?
# dis guys laugh me ehn //
s-649
KAD_13_Entering-University_MG__10
# dis guys laugh me ehn
This guy really laughed at me.
# mtschew //
s-650
KAD_13_Entering-University_MG__11
# mtschew
Mstchew.
# kai e no easy dat day //
s-651
KAD_13_Entering-University_MG__12
# kai e no easy dat day
Man, it was not easy that day.
I bin reason like sey [ make I just like # call am quit ] //
s-652
KAD_13_Entering-University_MG__13
I bin reason like sey [ make I just like # call am quit ]
I started thinking that I should just like... call it quits.
make I just dey go back to my papa house //
s-653
KAD_13_Entering-University_MG__14
make I just dey go back to my papa house
I should just go back to my dad's.
but # worst get to worst < I gats move on //
s-654
KAD_13_Entering-University_MG__15
but # worst get to worst < I gats move on
But if the worst happens, I have to move on.
# na life >+ be dat //
s-655
KAD_13_Entering-University_MG__16
# na life >+ be dat
That's life.
# so # onto di level now < # I push forward //= dey ask one or two questions like dat //= con meet some kind people //
s-656
KAD_13_Entering-University_MG__17
# so # onto di level now < # I push forward
= dey ask one or two questions like dat
= con meet some kind people
So on that note, I pushed on, asking one or two questions, and I met some kinds of people.
# di way de look me sef < you know di way I dress as per tinking sey [ # onto a big boy level < a jambito coming as a fresher ( you know ) want to get eh # di university life into my head like dat ] //
s-657
KAD_13_Entering-University_MG__18
# di way de look me sef < you know di way I dress as per tinking sey [ # onto a big boy level < a jambito coming as a fresher ( you know ) want to get eh # di university life into my head like dat ]
In fact, the way they looked at me, you know the way I dress, thinking that becoming a big boy... a new student, coming in as a freshman (you know), wanting to get uh... a hold on the university life.
# so # we con get to # a level wey be sey # [ we finished registration ] //
s-658
KAD_13_Entering-University_MG__19
# so # we con get to # a level wey be sey # [ we finished registration ]
So we came to a point where we finished registrations.
after some weeks like dat < de con tell us sey [ make we start lecture ] //
s-659
KAD_13_Entering-University_MG__20
after some weeks like dat < de con tell us sey [ make we start lecture ]
After a few weeks, we were asked to start classes.
# I bin tink sey na dat kind secondary school something wey be sey [ { we go con || we talking } ] # you know //
s-660
KAD_13_Entering-University_MG__21
# I bin tink sey na dat kind secondary school something wey be sey [ { we go con || we talking } ] # you know
I was thinking that it's that kind of secondary school thing where we will be... we'll be talking, you know.
# aha !//
s-661
KAD_13_Entering-University_MG__22
# aha !
Aha!
# di ting tire me //
s-662
KAD_13_Entering-University_MG__23
# di ting tire me
I was fed up.
# I con dey like spark for one of my guy //
s-663
KAD_13_Entering-University_MG__24
# I con dey like spark for one of my guy
Then I was complaining to one of my friends.
I say [ bros < # na so >+ di university dey ?//] //
s-664
KAD_13_Entering-University_MG__25
I say [ bros < # na so >+ di university dey ?
]
I said, 'guys, is this how things work in the university?'
# which kind uniform we wear now ?//
s-665
KAD_13_Entering-University_MG__26
# which kind uniform we wear now ?
'What kind of uniforms do we wear?'
na short knicker |c abi na # long trouser |c abi na long sleeve |c abi which one ?//
s-666
KAD_13_Entering-University_MG__27
na short knicker |c abi na # long trouser |c abi na long sleeve |c abi which one ?
'Is it shorts or pants; long sleeve shirts or what?'
# you know base on my secondary school experience //
s-667
KAD_13_Entering-University_MG__28
# you know base on my secondary school experience
You know, based on my secondary school experience.
but # di whole university ting was like a different gig for my liking //
s-668
KAD_13_Entering-University_MG__29
but # di whole university ting was like a different gig for my liking
But the whole college thing was like a totally different experience.
# so # when di lecture start now < # as per di usual parade < # con see chicks //= see guys //
s-669
KAD_13_Entering-University_MG__30
# so # when di lecture start now < # as per di usual parade < # con see chicks
= see guys
So when lectures started, as usual, there were lots of girls and guys.
everybody dey bubble |c dey shuffle > you know //
s-670
KAD_13_Entering-University_MG__31
everybody dey bubble |c dey shuffle > you know
Everyone was giggling, moving around, you know.
# so # first lecture come //
s-671
KAD_13_Entering-University_MG__32
# so # first lecture come
So had the very first lecture.
# I no go forget am //
s-672
KAD_13_Entering-University_MG__33
# I no go forget am
I won't forget it.
Maths 101 //
s-673
KAD_13_Entering-University_MG__34
Maths 101
Math 101.
mehn e no easy # after some years like dat for just some kind maths though usually no dulling as per kd guy now //
s-674
KAD_13_Entering-University_MG__35
mehn e no easy # after some years like dat for just some kind maths though usually no dulling as per kd guy now
Guys, it was not easy to solve some kinds of math after several years, but usually as a Kaduna guy there's no messing around.
# patapata na { one |r one } o //
s-675
KAD_13_Entering-University_MG__36
# patapata na { one |r one } o
It's a win-win situation, at most.
# no dey lose //
s-676
KAD_13_Entering-University_MG__37
# no dey lose
No loss.
# we gader draw //
s-677
KAD_13_Entering-University_MG__38
# we gader draw
We got a draw.
# after di lecture now < we comot //
s-678
KAD_13_Entering-University_MG__39
# after di lecture now < we comot
When the lecture was over, we got going.
# na den >+ I know wetin de call school market //
s-679
KAD_13_Entering-University_MG__40
# na den >+ I know wetin de call school market
That was when I got to know what they call the school market.
# kai you no need to try di kind jamz wey dey dere !//
s-680
KAD_13_Entering-University_MG__41
# kai you no need to try di kind jamz wey dey dere !
Man, you don't need to try the kind of things there!
see restaurant !//= see fries !//
s-681
KAD_13_Entering-University_MG__42
see restaurant !
= see fries !
Check out the restaurants, check out the fries!
# different kind of tings like dat dey you know //
s-682
KAD_13_Entering-University_MG__43
# different kind of tings like dat dey you know
There are different kinds of things there, you know.
wey be sey e go like shorten somebody pocket //
s-683
KAD_13_Entering-University_MG__44
wey be sey e go like shorten somebody pocket
Which will drain your pocket.
# but dat side attraction no too capture me o //
s-684
KAD_13_Entering-University_MG__45
# but dat side attraction no too capture me o
But those side attractions didn't really grab me.
# but mehn when I get to see di # kind babes wey dey dere < mehn my eye shun //
s-685
KAD_13_Entering-University_MG__46
# but mehn when I get to see di # kind babes wey dey dere < mehn my eye shun
But guys, when I saw the kind of ladies that were there, guys, I was overwhelmed.
# mtschew !//
s-686
KAD_13_Entering-University_MG__47
# mtschew !
Mstchew!
# I con dey reason //
s-687
KAD_13_Entering-University_MG__48
# I con dey reason
Then I started thinking.
# na school >+ carry me come |c abi na chicks >+ carry me come ?//
s-688
KAD_13_Entering-University_MG__49
# na school >+ carry me come |c abi na chicks >+ carry me come ?
Is it for school I came here or is it for the birds?
but onto some kind level like dat < { man must || # you know man must } flex like dat now //
s-689
KAD_13_Entering-University_MG__50
but onto some kind level like dat < { man must || # you know man must } flex like dat now
But when you get to a level like that, a guy's gotta... you know, a guy's gotta show off.
# so # as go con dey go now < I con # jam one chick like dat //
s-690
KAD_13_Entering-University_MG__51
# so # as go con dey go now < I con # jam one chick like dat
So as things unfold, I came in contact with a lady.
# her name na # Deborah like dat //
s-691
KAD_13_Entering-University_MG__52
# her name na # Deborah like dat
Her name is Deborah.
so # we con get to dey flenjo now //
s-692
KAD_13_Entering-University_MG__53
so # we con get to dey flenjo now
We got to the point where we were enjoying being together.
# so me and dis chick con dey relate onto # one on one level //
s-693
KAD_13_Entering-University_MG__54
# so me and dis chick con dey relate onto # one on one level
So this lady and I started a one on one relationship.
and lucky enough for me sef < di babe na jambito like me //
s-694
KAD_13_Entering-University_MG__55
and lucky enough for me sef < di babe na jambito like me
And luckily enough, the babe is a freshman like myself.
# she too no get experience //
s-695
KAD_13_Entering-University_MG__56
# she too no get experience
She also lacks experience.
{ me |c and her } are di same blind horses dey like run for di same # dark eh dis ting //
s-696
KAD_13_Entering-University_MG__57
{ me |c and her } are di same blind horses dey like run for di same # dark eh dis ting
She and I are the same blind horses that like to run in the same dark uh... this thing.
# so we con enter restaurant now //
s-697
KAD_13_Entering-University_MG__58
# so we con enter restaurant now
So we went into a restaurant.
# as per a sharp guy < # dis ting con dey reason sey [ na me >+ go # pay for her own food matter ] //
s-698
KAD_13_Entering-University_MG__59
# as per a sharp guy < # dis ting con dey reason sey [ na me >+ go # pay for her own food matter ]
As a sharp guy, it occurred to me that I'll be the one to pay for her meal.
as in kai # agbada don hook wire today >+ be dat !//
s-699
KAD_13_Entering-University_MG__60
as in kai # agbada don hook wire today >+ be dat !
In other words, it means man, I'm stuck!
# I reason my body { up |c and down } //
s-700
KAD_13_Entering-University_MG__61
# I reason my body { up |c and down }
I sized up the situation at hand.
Edit as list • Text view • Dependency trees