Dependency Tree

Universal Dependencies - Naija - NSC

LanguageNaija
ProjectNSC
Corpus Parttrain
AnnotationCaron, Bernard; Strickland, Emmett; Courtin, Marine; Gerdes, Kim; Guillaume, Bruno; Kahane, Sylvain; Ajede, Chika Kennedy; Onwuegbuzia, Emeka; Tella, Samson

Select a sentence

Showing 601 - 700 of 7278 • previousnext

s-601 # { me |c and di man } dey work //
s-602 di man dey pay me //= # me < I dey work //
s-603 { di man dey || { me |c and di man } dey || di man dey } pay me di # work meh I dey do //
s-604 # so naim my sister con talk sey [ # our last born ] &//
s-605 because I be twins < # na im >+ make I de call me Odion //
s-606 I be twins //
s-607 # my twin sister call us sey [ toh # as im dey so < im wan # start school o ] //
s-608 # sey im no fit dey &//
s-609 im na &//
s-610 because im na woman < sey im wan go school //
s-611 # naim I con say [ toh # we go gader money for you moh we put you for school ] //
s-612 # so na so >+ we con gader money o //
s-613 # con gader money //
s-614 all di work meh I dey do < if I do work like dis < na three thousand naira >+ I go save //
s-615 # na so >+ we con { do |r do } //
s-616 # con put my junior sister for school //
s-617 # dat one write WAEC //
s-618 as my junior sister write WAEC now < # she don write WAEC |c but # e no get money to &//
s-619 she take JAMB sef but &//
s-620 # she pass her papers //
s-621 she get two ninety //
s-622 # na im >+ she score |c but # no money { to || # to } forward //
s-623 # na so >+ she &//
s-624 { na || na im } >+ make am dey house now since last year //
s-625 # na im >+ she write WAEC //
s-626 # na im >+ make am she # take her JAMB //
s-627 # na im >+ make am she dey house now //
s-628 notin to do sef //
s-629 # so # I con dey work //
s-630 I con come # { X || X || X || Agwan~ || Agwandodo } //
s-631 I con dey follow one man dey work //
s-632 # na { me |c and di man } >+ dey work for dat place //
s-633 # so anytime we work < di man go give me money //= # anytime work < di man go give money //
s-634 # so as I con dey dat place < { my bro~ || my cousin broder } meh I dey stay wit for # Abuja for back of specialist < # e con tell me sey [ eh as e be so ba < # im no fit feed me again o ] //
s-635 # sey abeg make { I go do || I go do } pack my tings //
s-636 # make I go back //
s-637 naim I con say [ aha # why you go do like dat ?//= na you >+ de carry me come make I con stay //] //
s-638 # sey noting concern am o //
s-639 sey im < as e dey so < im no fit feed me again //
s-640 toh naim I say [ toh okay < # sey meh I go back to village //] //
s-641 naim I say [ toh okay < # as e be sey [ I no get anybody for village |c I no get fader |c I no get moder ] < # I no just fit carry myself go village ] //
s-642 # naim I con go dey s~ //
s-643 # e get { one || one } of our maigadi wey dey stay for shop //
s-644 # naim I con go dey follow { di || di } man dey stay for shop o //
s-645 # so as we dey follow di man dey stay < na dere >+ I { follow || follow } di man dey guard //
s-646 # naim I con gader small money //
s-647 # I con go rent house //
s-648 # na dere >+ na im I dey stay now //
s-649 so # na work >+ I even dey do sef //
s-650 # so na work >+ na im carry me come dis place //
s-651 na work >+ I dey work for # dis # Fidelity Bank //
s-652 # so na dere >+ we for dey work //
s-653 # naim de con say [ toh okay # dat place < de wan sell di land ] //
s-654 # sey de wan sell dat land //
s-655 meh all of us # pack comot for dat place //
s-656 sey meh we go find where we go # stay //
s-657 # na so >+ de do o //
s-658 # de con drag for di matter //
s-659 de no con sell di land again //
s-660 # so na so >+ we take dey dat place dey work now //
s-661 # my oga now < im don dey plan to travel out //
s-662 but I know sey [ if e travel out < # na me >+ e go leave for dat shop ] //
s-663 # but im wife no gree //
s-664 # di wife con go bring im junior broder //
s-665 # di wife < e just bring her junior broder for village //
s-666 na dat one >+ con dey stay di shop now //
s-667 # so my oga don travel now //
s-668 e travel out last month //
s-669 # so na so >+ we dey battle //
s-670 { any || # anyting } you do < { na she || na di woman } >+ na im go dey &//
s-671 # na im >+ go dey collect all di money //
s-672 # so I con tell di woman sey [ toh as e be so < # me < I ] &//
s-673 as I don learn work finish < make I do freedom //
s-674 # I wan comot //
s-675 me < I go &//
s-676 di woman say [ I no fit comot o ] //
s-677 # sey { I must || # I must } dey under di place //
s-678 # I con say aha //
s-679 # wetin I wan do for here again ?//
s-680 person wey dey teach me work don comot |c # and I don sabi work //
s-681 # wetin you want mah come here dey do ?//
s-682 # e say no //
s-683 sey me < I must stay //
s-684 # sey until di seven year make I co~ //
s-685 naim I say [ wetin I dey &?//] &//
s-686 # seven year < who wan dey teach me work ?//
s-687 # I go con dey here //= nobody dey teach me work //
s-688 # my oga don travel out |c # and you na woman //
s-689 { you no fit dey || you no fit dey } where I go con dey //
s-690 # who I wan &?//
s-691 { wet~ || who } wan teach me di work ?//
s-692 # e say no //
s-693 sey me < I must stay //
s-694 naim I say [ toh # madam < if na so < # I no stay again o //] //
s-695 # na so >+ I take comot //= con go dey do jobman for people //
s-696 # if I work < na two thousand >+ de go give me //= # if I work < na one thousand //
s-697 so I take dey feed myself |c # dey cloth myself //
s-698 so na so >+ me < I all waka |c me take dey do //
s-699 # na only one of # girl >+ don enter school now //
s-700 di rest < de still dey village //

Text viewDownload CoNNL-U