s-1
| okay // |
s-2
| toh # na well // |
s-3
| # make I talk { as m~ || about } my life { as moder now || as eh motherhood now } // |
s-4
| # I just born now # eh like seven months // |
s-5
| # kai when I dey pregnant < e no dey easy o // |
s-6
| # pregnant woman dey hear am chai !// |
s-7
| # if I no vomit today < if my eyes no dey turn me < &// |
s-8
| mtschew # e no dey easy { at all |r at all } kai !// |
s-9
| # dat time eh < # ah # na so >+ any &// |
s-10
| I no fit do anytin // |
s-11
| my husband just dey pity me // |
s-12
| na im >+ dey help me do some tings // |
s-13
| # kai our mama dem < de dey try o // |
s-14
| de dey try { well |r well } // |
s-15
| # but as I con born now < immediately I born < see as I con well // |
s-16
| everytin { f~ || eh # con } be like sey [ I no dey pregnant before ] // |
s-17
| everyting con dey a'ah // |
s-18
| # all di { headache |c { everyting |r everyting } |c every sickness } just stop kpai !// |
s-19
| I say [ ehn na so >+ e be ?//] // |
s-20
| # so we con born di pikin now < # drama con start // |
s-21
| # yes now < okay you born baby // |
s-22
| baby < as I { f~ || born } am sef < for { f~ || two } days < I no see di baby // |
s-23
| # because na # pretime // |
s-24
| di baby no reach time wey I take born am // |
s-25
| so de keep am for like one week // |
s-26
| # as I con see di baby now < see di tiny ting con small // |
s-27
| # con start to breastfeed // |
s-28
| ah to dey wake up for night < anoder work // |
s-29
| # anoder big work o // |
s-30
| I just dey wake up for night kai // |
s-31
| # sometimes ( my mama dey dat time //) she go help me carry small // |
s-32
| my husband too go carry small # { sotay |r sotay } &// |
s-33
| # because na only breastmilk >+ I dey give am // |
s-34
| I no give am any &// |
s-35
| # I no give am formula // |
s-36
| # so { small |r small } < # as three months reach < # di time wey she take dey wake up for night con reduce // |
s-37
| # I con still dey &// |
s-38
| I still dey give am only { food || breastmilk } // |
s-39
| I no give am formula // |
s-40
| e con reach six months ehen // |
s-41
| # when we reach six months < na she >+ no even collect breastmilk again // |
s-42
| one day < I con try am give am pap // |
s-43
| e collect am // |
s-44
| I say ah // |
s-45
| # okay !// |
s-46
| # so after some time < she con start to collect breastmilk again // |
s-47
| so # she { dey chop |c dey sleep |c everyting } // |
s-48
| na so >+ we con { dey do am |c dey rough am } { small |r small } // |
s-49
| # but even till now sha < she still dey wake up for middle of di night o //= still dey wake up // |
s-50
| but her hair don grow now // |
s-51
| na girl // |
s-52
| so I don dey plait im hair # { { small |r small } |r { small |r small } } //= dey buy cloth // |
s-53
| we dey take photo // |
s-54
| di girl < # she like to play with phone o // |
s-55
| { phone |c laptop |c telly } < all dose tins dey attract am // |
s-56
| # I no know # { wheder she wan do || { wheder na entertainment >+ she wan do now |c or wetin } } // |
s-57
| I no know // |
s-58
| we never know but &// |
s-59
| # she never even start to talk sha |c but we dey play |c we dey laugh // |
s-60
| # we just dey &// |
s-61
| we just dey // |
s-62
| we just dey like dat |c dey enjoy // |
s-63
| # as my mama stay with me one month < she don go // |
s-64
| na { me |c and my husband } >+ con dey do am # { { small |r small } |r { small |r small } } together // |
s-65
| I don even start work now // |
s-66
| so I don even dey carry am go creche // |
s-67
| # so at least < sometimes < me too < I go say [ I dey go { on || # on } break ] // |
s-68
| # when she go creche < I go fit work // |
s-69
| # I go come back for house for afternoon // |
s-70
| evening time < we go continue # wetin we just dey do // |
s-71
| # me < I dey work for local government // |
s-72
| I be government worker // |
s-73
| # ehn so for local government dere sha < if I go &// |
s-74
| # but di good ting be sey [ as I born pikin < e get as government take do am ] // |
s-75
| # I born pikin //= I get eh &// |
s-76
| # I dey # maternity leave for three months // |
s-77
| # I go three months // |
s-78
| when I come back three months < for dat three months now < as I resume work < # if oder people dey close for four o'clock < de gree make I dey close two o'clock // |
s-79
| # so I go close on time |c go carry pikin go house // |
s-80
| # so dis two o'clock one { go go f~ || go run } for six months // |
s-81
| after six months < # I go con start work again // |
s-82
| so e good as government do am // |
s-83
| my pikin go don almost reach one year # before I go con dey do work fully // |
s-84
| # so she go don dey strong { well |r well } like dat // |
s-85
| # even dat three months wey dey give us &// |
s-86
| but we still dey pray make de extend dis eh leave # as eh { doctor || hospital } say [ meh we dey do exclusive breastfeeding for six months ] // |
s-87
| # so if de fit make dis eh # leave meh e dey enter six months < for dey good because # even dat time < God con help me sha // |
s-88
| e get creche beside my office // |
s-89
| # I carry my pikin go // |
s-90
| so # as I dey work < # { I go go feed am |c go fin~ } so dat I go fit do dis { eh six months || # ehn six months } { full t~ || eh mtschew exclusive } wey de talk // |
s-91
| but # e get some people now < de no go fit do am // |
s-92
| # de no go fit do am because of deir work // |
s-93
| # { e || people } wey even dey private < na im >+ I pity pass // |
s-94
| # but ev~ &// |
s-95
| some people ( even some government people ) no fit do am if creche no dey your office // |
s-96
| wetin help me be sey # [ creche dey my office ] // |
s-97
| creche no dey my office now < e for no dey easy // |
s-98
| # but na wetin help me sha //= so < I con fit do am // |
s-99
| # di pikin don grow now // |
s-100
| she don dey chop now // |