s-902
| aha !// |
s-903
| can you imagine ?// |
s-904
| which kain girls be dose ones ?// |
s-905
| na Jew girls // |
s-906
| ah !// |
s-907
| you know sey [ dose Jew girls < na im >+ de form sey dem be Jew girl ] // |
s-908
| Jew ?// |
s-909
| de go do like sey [ de be city girls ] so dat you know when dey enter big place like dis ba < dem go know sey [ ah na babe >+ be dis ] // |
s-910
| dem no go know sey [ na noting >+ gum dem ] // |
s-911
| sapain no gum dem // |
s-912
| one naira no gum deir yansh like dis !// |
s-913
| mstchew hm !// |
s-914
| my name na # Bukola Ayaniyi // |
s-915
| # I be ogbonge madam for # soap making // |
s-916
| # I dey make soap because # { I no wan steal |c and I no wan be liability for my oga } // |
s-917
| # and as I dey do di soap < # no be sey [ na me >+ originate di soap before ] // |
s-918
| # { before |r before } # I get shop # where I dey sell provision // |
s-919
| # but later on < # tings do as e wan do // |
s-920
| # and me I no fit siddon # idle // |
s-921
| # dat's why one of my friend # wey im name be # Mama Funmi ( na my better friend //) # naim come tell me sey # [ im broda < # de don teach am soap for deir church //] // |
s-922
| # so as de come teach am < e come carry di # manual give me say [ make I go read ] // |
s-923
| # after I read am finish < # na so >+ I go buy materials // |
s-924
| # so di material for making soap start from # sulphuric acid // |
s-925
| # di second one na Tezapen // |
s-926
| # third one na { s~ || eh # caustic soda } // |
s-927
| # di fourth one # < na { ST~ || # STPP } // |
s-928
| # { soda ash |c # Nitrosol |c # perfume |c # liquid gel |c # or foam booster |c # or # formalin |c # wit colour |c and perfume } // |
s-929
| # na so >+ I start to dey mix soap // |
s-930
| # and I thank God sey [ # even dough # de never dey patronize me # as I want < but at least < # I still dey put something for table for my children ] // |
s-931
| # and I no &// |
s-932
| no be sey # [ all my cloth go come dirty for house # wey house go dey smell ] // |
s-933
| # I dey wash as I like // |
s-934
| # my children dey wash // |
s-935
| # we dey clean // |
s-936
| # my odour sef < my body odour # na correct one because # I dey put am correct perfume // |
s-937
| # di perfume wey I dey put start from ambipur // |
s-938
| # I dey put lemon fruit //= # I dey put eh { banana flavour |c # and so oda # perfume like dat } // |
s-939
| # wey be sey # if anybody { open my soap |c # smell am } < { e go ti~ || e go see } sey # [ dis one na correct one ] // |
s-940
| # and my soap e no dey # spoil cloth //= # e no dey wash cloth //= # e dey make cloth beta // |
s-941
| # you fit use am { wash ankara |c # wash jeans } // |
s-942
| # any type of cloth < you fit use my soap wash // |
s-943
| # and I dey do different types of colour // |
s-944
| # I dey do lemon colour //= # I dey do pink //= # I dey do blue //= # I dey do green # so dat make e dey entice my customers // |
s-945
| # or if de see am < ah which colour be dis one ?// |
s-946
| # even at times < I dey do orange colour // |
s-947
| # na so o !// |
s-948
| # so soap making < # na correct business o !// |
s-949
| # any woman # wey e no want im husband # make e dey take # cloth dey knock im head for house < # make e engage imsef # for petty work !//= make e dey do o !// |
s-950
| # e no good make person dey idle // |
s-951
| # na so o !// |
s-952
| # first of all < # if I want do like fifty liters < # I go buy sulphuric acid # //+ two liters // |
s-953
| # and dat two liters < # at di rate of # { one thousand |c # eight hundred } naira // |
s-954
| # one liter is nine hundred // |
s-955
| # I go buy Tezapen # six hundred naira // |
s-956
| # if I buy all dose tings < # I go &// |
s-957
| first of all # I go mix sulphuric acid # wit Tezapen // |
s-958
| # I go stir { well |r well } # make everyting melt // |
s-959
| # because sulphuric acid < # e dey hot { well |r well } // |
s-960
| # so if I don # stir am { well |r well } # make e melt < # I go put my { st~ || # caustic soda } for water // |
s-961
| # because # for fifty liters of soap < # I go use ten spoon of caustic soda // |
s-962
| # I go soak am for three liters of water // |
s-963
| # so if e don melt { well |r well } < # I go pour am // |
s-964
| # if I pour am { wit || wit } di ones wey I don mix # { dat # sulphuric acid |c and Tezapen } < # I go pour dat # caustic soda // |
s-965
| # I go stir am { well |r well } // |
s-966
| # even as you dey stir am < # you go dey see di smoke wey go dey come out # cause di tin dey hot { well |r well } // |
s-967
| # so after dat one < # I go still mix my # soda ash // |
s-968
| # I go put am for three liters of water // |
s-969
| # I go mix dat one too // |
s-970
| # if e don disolve { well |r well } < # I go pour am // |
s-971
| # I go stir am { well |r well } // |
s-972
| # { after dat sulphuric || after # em soda ash } < # I go put { STP~ || # STPP } // |
s-973
| # I go put dat one for three liters of water # because # I no dey like # make my soap dey watery // |
s-974
| # so if I don do am like dat < # all dose tings < na so >+ I go dey put am # { three || three } liters of water # till # e go reach # eh perfume // |
s-975
| # if I don mix everyting like dat < # if water no come reach # di amount wey I wan make e reach < # I fit add am water # because # if soap tick { well |r well } < # people go buy am // |
s-976
| # if e too watery < # e no go dey foam { well |r well } // |
s-977
| # so na so >+ I dey do my own // |
s-978
| # and I dey tank God for my life # because I no be liability for my husband // |
s-979
| # people dey buy o !// |
s-980
| # even dis my sista < # na my soap >+ im dey use wash cloth // |
s-981
| # all of my compound people dem dey buy # soap for my hand // |
s-982
| # dem dey buy am // |
s-983
| # people for street sef < dem dey buy # cause de know sey [ my soap dey okay ] // |
s-984
| # I fit carry one # make you perceive di odour // |
s-985
| # di ting dey okay { well |r well } // |
s-986
| # you fit use am wash plate //= # you fit use am wash cloth //= # you fit use am { wash your toilet |c # mop your kitchen } // |
s-987
| # { anywhere |r anywhere } < # { anyting |r anyting } < you fit use am do // |
s-988
| # nothing do am // |
s-989
| no shaking // |
s-990
| # so # I dey kampe // |